Escuchar "Oga Doctor" Amazon Music Unlimited (ad) Prueba Gratis 30 días

Letra de Oga Doctor

What I get to say Many go gree with me The others criticize but know na true This e matter don cause plenty problem for many man And for woman tooMental torture Confusion of the mind Unhappiness Unnecessary stressCome hear things doctors dey do with our woman For inside them room Come hearTalk wetin you see I go talk Talk wetin you see The thing I see Talk wetin you see I must talk Talk wetin you see The thing I see Talk wetin you see Doctors dey do Talk wetin you see For them clinic Talk wetin you see With our woman O ya o come hear oTell tell us When our woman go Tell tell us To see the doctor Tell tell us Doctor fit tell am Tell tell us Before the check up Tell tell us To commot dress Tell tell us To lie for bed Tell tell us When them lie for bed Tell tell us To open them leg Tell tell us Doctor go take him hand Tell tell us To rub the breast Tell tell us Him say him dey check Tell tell us Whether cancer dey Tell tell us Doctor go take him hand Tell tell us To rob the you know Tell tell us Wetin him dey find Tell tell us I don't know Tell tell us The thing wey I know Tell tell us Many man no like Tell tell us Make man doctor dey touch Tell tell us Our woman like that Like that Like that Like thatWe need women doctors To treat our women for us To solve them private problems To deliver them pikinNa so our ancestors Bin dey do before Wetin concern man inside woman problem Me I no gree o Make another man take Take him nonsense hand To rob my woman body Me I no gree o Make another man take Take him nonsense hand To rob my woman you knowWe must all come together To fight and change this system We must all come together To rectify things now We must encourage women To do like our ancestors do Make women start to do Like our ancestors do Women do Like our ancestors do Women do like our ancestors do