Letra de Last Mugu
E commot for house him knack him tie him knack him coat Last mugu Inside this hot sun see as him dey sweat him dey sweat like goat Last mugu The year 2000 don come African still never see road Last mugu Be African wey carry foreign things for head reject him own Last mugu Be African wey dey look down on him culture and heritage Last mugu Be African wey no wan free himself from colonial bandage Last mugu Be African leaders wey dey steal our money and resources Last mugu Visionless leaders no fit Africa on level of world forces Last muguLast mugu na ode pata pata o o Last mugu If dém call you last mugu my brother him no good e o Last mugu Last mugu na ode pata pata o o Last mugu If dém call you last mugu my sister him no good e o Last mugu