Letra de Plenty Nonsense
(İnstrumental) You go see nonsense thing Wey go make you just dey cry You go cry? blood go commot from you eyeYou go see nonsense thing Wey go make you just dey vex You go vex? till you break your head?So fire engine go come quench fire Dem go forget bring water They tell you to quench the fire you must payIn the name of free education Jakonde build school for poto poto The schools no get window Pikin don carry table chair to schoolPolice no get better salary So arm robbers dey rob, dey go They make police stand for road Disgrace themselves they beg e moneyBribery and corruption Come enter our body Honesty no dey pay again Na illegal business dey prosper?When Babanginda dey spoil Nigeria Abiola no talk against am He follow am dey chop, dey enjoy Together they want make Nigerians craze
